18 December 2020
Rapper Eminem don apologise to fellow singer Rihanna afta one song wey leak see am tok say im 'side' wit chris Brown.
Eminem apology dey come afta one viral video bin comot wia di singer wey e real name na Marshal Mathers bin allegedly tok say "of course I side wit Chris Brown..."
Di lyrics of di song bin dey torchlight Chris assault on Rihanna for 2009. Chris chop arrest and even plead guilty before dem sentence am to Community service and compulsory anger management class.
Eminem tell di Under my Umbrella singer inside di song Zeus wey dey di new album say: I apologise, Rihanna for dat song wey leak, I dey sorry, e bin no mean to cause you pain, e bin dey wrong of me.
Di album wey follow January Music to be Murdered By come out on Friday.
Wen di track leak last year, Eminem tok-tok pesin tok say: "Dis na leak of something wey dey over 10 years old. Afta Eminem record am, im scrap am come rewrite am."
For e new track, Eminem admit say di original lyric "dey wrong of im".
Eminem and Rihanna don collabo many times, including di 2010 US number one single Love the Way You Lie, as well as Numb for her 2013 album Unapologetic and The Monster from The Marshal Mathers LP 2 for 2013.
Di rapper new album feature collaboration wit Dr Dre, Ty Dolla $ign, J Premier and Skylar Grey.
ncG1vNJzZmivp6x7o67CZ5qopV%2BltqWzyKdmraeinnp2gZJvcG1uaQ%3D%3D